The Voice UK 2017: Mo Adeniran don Win am!!!



Mo dey work night shift for hotel but hin don make up hin mind to become succesful artiste.

The 21 year old Nigerian singer been suffer tragedy as hin loss one of hin close padi wey die of drug overdose before hin enter the competition.

Mo na adopted pikin wey dey among family of three but hin no too tey for dere as hin adoptive mama been dey abuse am.

Mo been sing Iron Sky by Paolo Nutini for hin first audition, but na Jennifer Hudson hin choose as hin mentor even as na all judges been show interest for hin mata.

As hin don win now, Mo go enter studio straight away with top production team to record a whole EP rather than just the one single as usual, wey go debut  the same time with the one-off ITV special, The Winner's Story.

Watch Mo as hin sing hin winning song "unsteady"...



Comments

Popular posts from this blog

Podcast: Lokal FM Meets... Kshow The Maestro

Podcast: Wetin Be Good Friday?

@lokalfmNG